mail me lyrics Send Lyrics Updates into my email! (feedburner)

I no fit shout – Lyrics – Frank Edwards


I no fit shout o
Haa haa eeee
I no fit shout o
Eeeeh
Mi o le pariwo… pariwo
God na elele… elele
Esu alele… alele
God na elele… elele

E don tey wey You dey love me
E don tey wey You dey cover me
When I was a little boy o
Suffer suffer no be play play…..ah ah
I cry I tire o
Water finish for my eyes eh
I go sell under the rain o
I go sell under the sun
My mama carry my matter for head o
Say my pikin no go die
She pray, she tire o
Water finish for her eyes o
If no be God o

I no fit shout o
Haa haa eeee
I no fit shout o
Eeeeh
Mi o le pariwo… pariwo
God na elele… elele
Esu alele… alele
God na elele… elele

Jah jehovah o
Na You change my life o
You do am sotey… sotey
Ugochuchukwu don dey work
Baba carry me do what You like o
I throw-way salute o
I yea, I yea
Everything I touch
E dey work
Everytime I pray
You dey answer
Every song I sing
E dey sell
Na which kind of love be this eh
You dey carry me like baby
You be my everything

I no fit shout o
Haa haa eeee
I no fit shout o
Eeeeh
Mi o le pariwo… pariwo
God na elele… elele
Esu alele… alele
God na elele… elele

E no matter who you be
E no matter wetin you dey face o
Ha ha
Almighty Father o
Na Him go do am for you
He go do am sotey
Bad belle people go vex
The more they vex o
The higher you go dey go o
Tell me wetin your son go give you Baba

I no fit shout o
Haa haa eeee
I no fit shout o
eeeeh
Mi o le pariwo… pariwo
God na elele… elele
Esu alele… alele
God na elele… elele



  • All Artistes Index
  • Random Posts

    No comments:

    Post a Comment

    Newer Post Older Post Home